Nigeria vs Morocco Wafcon final: Stats, tins to know about di Super Falcons and Atlas Lionesses journey

0
How Nigeria and Morocco cruise to 2024 Wafcon final

Wia dis foto come from, Justina Aniefiok/Caf Women's Football X Wetin we call dis foto, Foto mix of Nigeria Super Falcons and di Atlas Lionesses of Morocco celebration

23 July 2025, 10:40 WAT New Informate 2 hours wey don pass

Football fans don dey look forward to di final of di 2024 Women's Africa Cup of Nations wey go happun on Saturday for Rabat, Morocco.

Nigeria wey be nine-time champions go face host nation Morrocco wey dey hope to win dia first continental title.

Nigeria beat South Africa 2-1 on Tuesday while Morocco defeat Ghana 4-2 on penalties same night.

Di West Africa football power house Nigeria and dia counterparts from North Africa don come a long way to reach di final of di 2024 Wafcon finals.

Make we chook eye for dia journey to di stage wey oda kontri bin dey eye but no dey successful.

Group stage

Hosts Morocco bin dey Group A of di tournament wit Zambia, Senegal and DR Congo.

Morocco and Zambia play 2-2 draw for di opening match. Dem beat DR Congo 4-2 and finish dia group match wit 1-0 win against Senegal.

Morocco top Group A wit seven points, di same wit Zambia wey finish second for di group but Morocco pass dem wit goal difference.

Morocco score seven goals while Zambia score six goals.

For Nigeria, dem bin dey Group B wit Tunisia, Botswana and Algeria.

Nigeria sama Tunisia 3-0 for dia opening match, beat Bostwana 1-0 and draw 0-0 wit Algeria.

Dem finish top of Group B wit seven points and four goals. Algeria finish second for di group wit five points.

South Africa top Group C wit seven point, Ghana finish second wit four points while Mali qualify as one of di Best Loser from Group C wit four points.

Quarter-Finals

Sake of say na 12 teams wey dem divide in to three groups participate for di tournament, Round of 16 no dey.

Di competition move straight to di Quarter-finals wia any team wey lose dey go house straight.

For dis round, Morocco wey top dia group face Mali wey be di Best Loser for Group C.

Morocco sama Mali 3-1 to reach di semi-finals while Nigeria flog Zambia 5-0 to qualify.

Algeria and Ghana play goalless draw , di same scoreline wit South Africa and Mali for open play.

Dis two matches enta extra time and e later end for penalties. Ghana win Algeria 4-2 on penalties while South Africa beat Senegal 4-1.

Semi-finals

Tension bin don begin rise for dis stage as di last four face each oda.

For di semi-finals Nigeria beat South Africa 2-1 while Morocco beat Ghana 4-2 on penalties afta Full-time end 1-1.

Nigeria and Morocco Stats for dis year Wafcon so far

Morocco

Morocco dey lead di top scorers list, dia ogbonge player and Captain Ghizlaine Chebbak get four goals already.

Dis na Morocco second Wafcon final and na dia first back to back final.

Morocco score 11 goals for open play for dis tournament, dem score di highest goal against DR Congo [4-2].

Morocco semi-final against Ghana wey end for penalties na dia first shootout for di tournament.

Dia na Morocco fourth appearance for Wafcon, dem participate for di 1998, 2000, and 2022 editions.

Nigeria

Nigeria concede dia first goal for dis tournament afta South Africa score dia penalty for di 60th minute.

Nigeria neva concede any goal for 'open play' for dis tournament.

Nigeria don score 11 goals for dis tournament and only one against South Africa be penalty.

Nigeria don get nine different goal scorers for dis tournament.

Chinwendu Ihezuo be top highest goalscorer for Nigeria she get three goals.

Dis na Nigeria 10th final for Wafcon and dem dey try to win dia 10th title.

Click here to read article

Related Articles