Premier League fixtures: Mbeumo, Kudus, Ait-Nouri, Jackson and Africans to watch for di 2025-26 season

0
Di Africans to watch for 2025-26 Premier League

Wia dis foto come from, Getty Images Wetin we call dis foto, Mohammed Kudus and Bryan Mbeumo don land for new environment for Premier League, while Habib Diarra go make im debut for England top league

Author, Rob Stevens Role, BBC Sport Africa

3 hours wey don pass

Di 2025-26 Premier League campaign go start on Friday, wen Liverpool go begin to defend dia title for home against Bournemouth.

Egypt star Mohamed Salah na di reigning player of di season and e go dey try collect im fifth golden boot as e go form new front line for the Reds wit big-money signings Hugo Ekitike and Florian Wirtz.

Plenty oda African stars don secure big transfers for dia side, and new players don land from countries like DR Congo, Morocco, Mozambique and Senegal.

Meanwhile, 50 players from di continent fit get dia Premier League season cut short becos of di 2025 Africa Cup of Nations (Afcon), wey go run from 21 December to 18 January.

BBC Sport Africa don look some of di players wey dey settle into new teams and dey try make impact for di next nine months.

Mbeumo fit restore United to former glories?

Cameroon international Bryan Mbeumo na di biggest African transfer dis close season, as e join Manchester United for £65m ($87m).

Di 25-year-old forward score 20 league goals and get seven assists for Brentford last season but now e go face bigger challenge for "di club of im dreams".

United dey rebuild under coach Ruben Amorim afta dem finish 15th, di worst performance wey dem don get for Premier League history.

Mbeumo go face pressure immediately to perform wit oda big-money signings Matheus Cunha and Benjamin Sesko - United don spend £200m ($271m) on di attacking trio - even say dem no go play European football dis season.

Evirybody sabi say Mbeumo like play piano and chess, but now United need am to play correct tune and use better strategy for pitch.

Kudus fit replace Son?

Wia dis foto come from, Getty Images Wetin we call dis foto, Kudus na die first player wey move directly from West Ham go Tottenham since 2011, wen Scott Parker leave east London go White Hart Lane.

Anoda big transfer na wen Mohammed Kudus end im two-year stay wit West Ham and join Tottenham Hotspur for £55m ($74m).

Di Ghana midfielder perform well for im first season for east London but im second season no too sweet as e struggle wit Graham Potter wing-back system.

Kudus shine well for Ajax and na why Spurs dey expect di 24-year-old to bring back dat form.

Playing Champions League again na one reason why e move go north London, and the Black Stars man also like the chance to play under new Spurs coach Thomas Frank, wey come from Brentford.

"From wia [Frank] come from, and si kind talent wey e don develop to become better players, na big reason why I wan work under am" Kudus tok.

Wit Spurs legend Son Heung-Min don waka and James Maddison go miss most of di season sake of injury, Kudus fit play key role from di beginning.

Ait-Nouri fit help City rediscover dia swagger?

Wia dis foto come from, Getty Images Wetin we call dis foto, Rayan Ait-Nouri follow for the Manchester City team wey Saudi club Al-Hilal beat for Fifa Club World Cup.

Afta dem drop to third place - and end 2024-25 witout any big trophy - Manchester City dey plan to fight for di title again.

Di Etihad team act fast for transfer window as dem sign left-back Rayan Ait-Nouri, and di 24-year-old don already play for City since im £31m ($41.5m) move from Wolverhampton Wanderers.

Di Algeria international, wey call the move "a dream come true", start three games for Fifa Club World Cup befor Pep Guardiola team comot for round of 16.

Ait-Nouri dey attack well from wing-back even as Wolves struggle last season, e score four goals and get seven assists, and sometimes dem use am for forward role.

Afta e don adapt to City possession style, Guardiola go surely want make im new player improve im attacking numbers.

Six bid for survival for Wearside

Wia dis foto come from, Getty Images Wetin we call dis foto, Simon Adingra na di person wey set up di two goals for Ivory Coast win for 2023 Afcon final, but e no get enough play time for Brighton last season.

Sunderland don come back to Premier League for di first time since 2017 and dem don busy for transfer market, sign 11 players.

And dem recruitment get African flavour, as six of di new players come from di continent.

Di Black Cats spend club-record £30m ($40m) on Senegal midfielder Habib Diarra and also add DR Congo duo Arthur Masuaku and Noah Sadiki, Mozambique defender Reinildo and Moroccan winger Chemsdine Talbi.

Ivory Coast Afcon winner Simon Adingra also don leave south coast go north east after e start only 12 league games for Brighton last season.

As one of di few players wey get Premier League experience for Sunderland, the 23-year-old winger go need use im skills turn to points if dem wan avoid quick return to Championship.

More moves to follow...

Wia dis foto come from, Getty Images Wetin we call dis foto, Nicolas Jackson wey win Club World Cup trophy wit Chelsea fit leave Stamford Bridge

Kudus don leave London Stadium but West Ham still get African player afta dem pay Slavia Prague £19m ($25.5m) for El Hadji Malick Diouf.

Irons coach Potter talk say the 20-year-old Senegal wing-back dey "hungry and ambitious".

"I believe say e go be better addition to the team," e add.

DR Congo centre-back Axel Tuanzebe, meanwhile, go try avoid second relegation back-to-back, as e leave Ipswich Town go Burnley.

And whether teenage left-back Adam Aznou fit enter Everton first team for dia first season for new stadium after the Moroccan join from Bayern Munich na another question.

As transfer window go still dey open till Monday, 1 September, plenty time still dey for more African transfers.

Click here to read article

Related Articles